I came across this and found it absolutely innovative and funny. It been in pidgin does not change its potency though. Enjoy!
1. The Lord is mai shepherd
I dey kampke
2.He make mi sidon for where betta dey flow
Come put me next to stream make mai bodi
Thermacool.
3.He panel beat mai soul come spray am white,
come dey lead me dey go through express road of
righteousness for sake of Hin name.
4.Walahi!, if I waka pass where arm robber, 419
and juju people borku, come even join okada reach
valley of the shadow of death sef, mai bodi dey
inside cloth. Your rod and staff nko?
Na so dem dey back like bone dey comfort me.
5.You don prepare Banga and starch make I chop.
All mai enemies dey look anyaya.
You rub me for head wit Vaseline Intensive
Lotion. Mai cup na Ogunpa wey come overflow.
6.True true, betta life and mercy go gum mai
back till I quench. And man go tanda for God house
sotey sotey from Lai lai to lai lai.
GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO.
AMIN!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment